Naija woman send birthday wish give her husband side chic and d matter dey scatter people head




















Oya make una come hear this story o, i hear say e get one woman wey dem dey call Atinuke wey just dey shake the whole internet. This woman do wetin just tire me wey i no just understand.


Wetin I hear be say her husband dey carry another woman, and the woman just nack 29years. Na so Atinuke just talk say she go write yarn give the side chic through Joro wey be relationship expert. 
Na im Atinuke just dey thank the woman say the woman they make im husband happy, say she dey make the husband make im dey work hard, say na the woman sef they motivate her wey be Atinuke to be better woman. 
Abeg which kain talk be that???

She come add join say, she don realize say the woman no go leave him bobo for am and him bobo no go leave am, so make the two just dey happy.' - IMAGINE! which woman go fit accept that kain thing.

The thing vex plenty naija people dem.

Abeg make una follow me read wetin she send for down:






















#shiorrr, this matter tire me walahi! If na me eh, wetin i go do that side chic eh, body go tell am, I trust myself.... 
Share on Google Plus

About Mimi

0 comments:

Post a Comment