Breaking News: Big Brother Naija Housemate, Kemen Has Been Disqualified And Evicted For Playing Sexual Hide and Seek! Watch Video

























Kemen! Kemen! Kemeeeen!!! How many times i call you???
which kain Konji make you lose 25million like this?? shuuu!!! 
My brother, Even the people wey dey do you from your village dey shocked! #shioorr!!!




Because of wetin happen, big brother come get wetin oyibo dey call 'disciplinary session' with Kemen and Tboss (Tboss na the girl wey Kemen dey totori her body for night). 

So as all of them sit down, na so big brother or u fit say 'biggie', just announce "You have been found guilty of violating the Big Brother rules. You're hereby disqualified from the Big Brother house immediately,".

Na so the other housemates just halla "yeh!!". The matter tire everybody.

But una sure say the girl no dey enjoy am? This one wey she no even react, she just turn show Kemen her backside. Because if na me dem do that kain thing eh, I go first wooze am slap before i go think of object to carry.

Oya make una help me watch the video of how Kemen bin dey do the thing for down:




      video of Kemen sexually harassing Tboss
Share on Google Plus

About Mimi

1 comments: