Different Tribes Disown Pablo Ayodeji, the Guy whose date returned their outing money after he called her a hungry broke bitch


keep the change bae and Pablo Ayodeji
Shey una remember this Pablo Ayideji guy wey call one girl hungry bitch because the girl no gree for am after im don carry am go outing, and the girl no even curse am back, she just transfer the money give am back with extra change. Oya click here for that tori.

Na im everybody come vex for this guy o, im no get wetin dem no talk, many people just dey use the guy do yeye, some even do meme for the guy. 

The one wey come scatter my head na when all the tribes start to dey disown the boy including the yoruba wey im come from. Even igbo, Edo, and Ijaw sef disown am.. 

This one na wetin oyibo people dey call 'negative fame.

Oya make una see the way dem disown am for down:



I still throway cap for the babe, the name wey everybody dey call am now na keep the change bae" lol!. 
I hear say First bank dash am NGN5000, come even put her face for one family thing like that. I dey happy for her o.
Share on Google Plus

About Mimi

2 comments: