Man arrested for raping 13-year-old in-law!!!



How person go get mind rape small pikin especially the one wey relate to am???

Ogun State Police Command don arrest a 35-year-old, Kingsley Chigbo, for allegedly raping a 13-year-old girl, wey dem talk say na him wife younger sister.

Na the police spokesperson, wey dem dey call Abimbola Oyeyemi, yarn am give PREMIUM TIMES on Sunday, he talk say the suspect commit the offence‎ for Ijoko Ota town of the state.

Mr. Oyeyemi come talk say dem report the matter to the police for Sango Ota Divisional Headquarters by Peju Osoba, the immediate past Ogun State Coordinator of Child Protection Network, CPN.

Mrs. Osoba report say na one of her organisation’s staff for Ota wey go for one enlightenment talk with students of Bannis College, Ijoko Ota, give am the tori.

He talk say after the enlightenment talk, the little girl come call the said staff to one corner, she come confess to her say her elder sister’s husband don dey sleep with her by force, him dey threaten her say him go kill am if she tell anybody.

Na so police come go arrest the suspect.

Mr. Oyeyemi talk say the man sef confess say him rape am true true after dem don confront am with the girl. 
Mr. Oyeyemi come talk say the Commissioner of Police, Ahmed Iliyasu, don order say make dem investigate the suspect.

Abeg o my readers, wetin una feel say dem suppose to this man?
Share on Google Plus

About Mimi

0 comments:

Post a Comment