BREAKING NEWS!!! Zamfara Corper Beaten, Flogged And Thrown In Prison For Disciplining The Child Of A Very Rich Man!!!



Abeg wetin this Nigeria wan turn into??? Why corper wey federal government send make him serve him father land go dey receive this kain treatment.



















The corper name na Michael and him dey serve for NASARA STANDARD ACADEMY kaura Namoda wey dey for Zamfara state. 
Na im one nonsense girl wey be the daughter of Sahabi liman who be one of the wealthiest man for kaura Namoda come dey disturb for class. As teacher wey person be, no be to discipline am?. Na so Michael tell the girl make she kneel down.. only!!!

This yeye girl wey dem don spoil im life finish go report to her papa and her Papa sef wey no dey shame come go call police for the corper. 

If you see how dem panel beat the boy face eh, scatter im body, beat am like person wey thief for central bank.
As other copers wan come help the boy, if you see as them police people wey suppose be our friend, wey suppose protect us come they tear dem slap eh! Dey threaten their lives with gun, dey push them away like Maluu... shioorr!!!

The guy dey inside cell with big big wound for im body, no be say the federal governement dey pay them the #19800 wey be their salary o. 
Na soso empty belle the boy they use teach everyday.

Wetin Michael Mama and Papa go talk now?? Na crime to be poor person for this naija?

So i wan use this opportunity to call on:

The state Government;
The State Coordinator NYSC;
The Emir of Kaura Namoda;
The Commissioner of Police;
The Federal Governement;

Every person wey dey wear Khaki and Jungle boot for that Zamfara state and for the whole Nigeria. Make una come shake ground make them do something, this matter no fit die like that ooooooo...

#Tatafo
Share on Google Plus

About Mimi

0 comments:

Post a Comment